
Reinildo Mandava last minute equaliser for Mozambique break Ghana hearts and deny dem qualification for de knockout stages of 2023 Africa Cup of Nations despite say de Black Stars lead 2-0 afta 90 minutes.
Ghana bin comfortably dey in de lead thanks to two goals from de penalty spot by Jordan Ayew.
Wit only four minutes remaining before full-time, Ghana defenders go sleep.
First dem concede penalty wen de referee judge say Andre Ayew handle de ball inside de box. Geny Catamo convert de spotkick a minute into added time.
Den Reinildo Mandava rise high inside de box to head home de equaliser wey deny Ghana progress into de last 16.
